Naija, I hail o!
na only 4 naija you fit win
Aeroplane by loading ₦200 MTN
card!
Very soon Etisalat go say recharge
₦200 & win a big ship!
Then Airtel go come follow say,
recharge ₦100 and win Benin
republic.
Glo go just kuku say recharge
₦500 and win Nigeria, bcoz there
colour na green!
Na only for Nigeria you go see fish inside "MEATPIE."
Na only 4 Naija we dey count
money after we withdraw am
from ATM machines!
Na only 4 naija PHCN dey say, win
a brand new Generator if you pay
your electricity bill.
Na only 4 naija people dey horn 4
traffic light make e quick change
from red to green.
Na only 4 naija pharmacy dey sell
coke, recharge card, chin chin, puff
puff, ogogoro & beer.
Wetin you no fit see 4 anoda
country, e dey happen 4 here...
Naija, I hail o!
Created at 2013-11-09 21:37:46
Back to posts
UNDER MAINTENANCE